CORRIGER LES PAROLES

Paroles : GLORY (The Genesis)

If I tell you my life how I take reach here
You no go believe who dey there abeg bring Chair
One polo, one Jean, rotten palm slippers
12 years old I don stop to de sleep house

Ring the bell 12 o’clock suppose be breaking time
But to me and Kevwe Omo Na taking time
Tear people school Bag remove them belongings
Deep down I don’t know what I’m becoming

Headphone for my ear one old Walk man
De jam 2pac of course I no get work naw
Morning till night we de area de gamble
De struggle Police wear us government bangle (Handcuffs)

My role model that year Na them bros Ogbe
Na when e die I know say na ole ole (armed robber)
Community de find us we de Bush de kush
Officer relax, you never know who you de push

(Chorus )
If not for Jehovah, my life would have been over
Na baba God de bless me oh e de bless me oh
I no be super man oh but my life de him hand oh
Na baba God de bless me oh e de bless me oh
VERSE 2 (Rap)
When I tell them my dream dem go start to laugh
Erigga relax who don blow with rap for Waff
Okere prison de come you go soon join your boys
But deep down I know say the world go hear my voice

From streets to streets de kpuff who talk say e dope (rap battles )
Erigga good the problem be say e broke
So when time reach to chose Bible or Riffle
I chose Bible (skunk wrapped shaped like Bible) flood the back streets with kpo (weed)

Money start to enter I begin book session
More video, more show less police station
No more police statement now Na account statement
Call dem obor ( his boys) how far how una make that payment

(Chorus)

VERSE 3 (Rap)
Na the moral for the story give up no join
E fit de hard now country man stay on point
Fail to plan my brother Na plan to fail
Who go better go better Na tay e de tay

No be stone you de cook my brother Na beans
When e done tear everywhere like rugged jeans
I don see men hammer I don see men broke
To the point them no fit even fit buy gbana smoke
Who belly full go hungry my brother where you
Na brain Broke today your men go throw away you
Money de but I de grind like up coming
Anything when make me fall e no go funny

CHORUS TILL FADE