AJOUTER PAROLES
Top 100
Sorties d'albums
artistes
Communauté
Espagnol
Portuguais
Anglais
Correction Paroles
Welcome to Warri
par
ERIGGA PAPER BOI
Retour
Paroles
Yes I Dey Always They Tell People Say For This Town We Get 3 Different Community Ekpan, Agbasa, & Okere (Agbasa) If Dem Hold You Say U Thief Phone U Dey Pay 4 stabiliser and Phone (Okere) If them Hold U Till Day Break Na Bottom Stairs U dey Sleep But (Ekpan) If Dem Wan Give U Post Dem No Dey Look Say U Be Indigene Na The Kind Mark Wey Dey Ur Body Dem Take Dey Give U Position If U Get 1 Eye U Be Vice If Ur Hand Dey Seaze U Be P.R.O If U Get Bullet Mark U Be D.C If U Waka Dey Wave U Be Press (area I hail oooooo) Old Warri Welcome To warri Where All The Mama's dey Vex F*ck Up No Dey Sawa She Tatto am 4 Her Breasts Her Son Dey Press Two Kala Under Her Dress She Ready Shoot Olokpa If Them Come Her Address (Rest) No Be Today She Don Dey See Her arrest Area Mama 4 D Hood U No Wan See Her Vex Apart From Cocaine Nothing Mama No Dey Sell 1999 Dem Lock Mama Throw Her Inside Cell Dem Carry Her Pa** Me Where I For Dey Play Monkey Post They Almost Blast Me With Slap I Take Off With My Kittos The First Time I See where Dem Stab Person Neck Na 94 Two Seconds Naso Andrew Fall Andrew Mama Dey Bust Cry Who Do Am Don Run Full Compound Dey Pack Egbe The Police Dey Come U Suppose Know Egbe Dat Guy Matter Na Dead Him Fit Arrest The Full Area If e Enter He Head I No Be Mumu Aje I know The Area Well Full Agbasa, Igbudu Dem Know My Matter There Odumu, Sobo, Ejegba We Get House 4 Ekpan Go Udu, Oruvworun The hands sound I No Be Mumu Aje I Know The Area well Warri Crisis 99 I Dey There Marine gate, iyara We Get House 4 Ekpan Go Ogborikoko Ask na The hands sound Dem Butcher My Friend Hand 4 Agbasa Feast With Old Cutla** Naso Fight Take Enter Street Igbo Market Men Dey Run Enter People Shop Carry 2 Wrong Set Of Shoes Till the Feast Stop Police Dey Shout If U Move I No Fit Stop Follow Me Enter Ejegba I Enter U top Our Biggest Fright Na Ekpan Hilux Light For Night Those Men No Get Joy Beating Na their Appet**e I Dey Ceiling When Dem Carry All My Guys Go Government Bangle For The Hand Let D Dice Roll Papa Dey Waka Police Matter 3 Weeks Straight Native Doctor & Pastor For Here Dey Lick Plate Imagine Say The Full Area No Get Big Man Wetin Concern Signboard And Who Dey Sell Weed Man Dry Bread and Sadine Plus Igbe Fanta Naim We Dey Chop After We Don Smoke For Downtown I No Be Mumu Aje I know The Area Well Full Agbasa, Igbudu Dem Know My Matter There Odumu, Sobo, Ejegba We Get House 4 Ekpan Go Udu, Oruvworun The hands sound I No Be Mumu Aje I Know The Area well Warri Crisis 99 I Dey There Marine gate, iyara We Get House 4 Ekpan Go Ogborikoko Ask na The hands sound Marine gate, iyara We Get House 4 Ekpan Go Ogborikoko Ask na The hands sound Yes Naso Eee Be For The Same Warri Where We Dey Area & Characters Iyara (NairaBet) Isido (Vigilante) Obire (D.J) Ereku (Dustbin) Ogedegbee (Waka well) Pesu (Confra Boys) Victory Avenue (Beggi Beggi) Hausa Quarters (Ol chains) Garage (Ticket) Oppe (Gamblers) Ometa (No Neighbor) Agbasa (No Company) Ogunu (No Market) Makaiva (Gbo Gbo) Okere (Juju) Ajamoga (Link Road) NPA (Diesel) Ogbangwe (Judge Judge) Avenue (Depot) Airport Road (Ole) Ekpan (Murder) (Abeg) Day Break Everywhere Bust Men Is The Erigma 2 I Know U Waited 7 Years 4 Dis men Guess What U No Wait In Vein Aswear Burst Una Screen Guard (No Limit) All The Jam Dey Bang Abeg Commot Ur Leg 4 High Tension ooo
clip
Ton pseudo sera publié. Laisses les champs vide pour rester anonyme.
Soumettre
Modal title
×
Ajouter un média
Video URL?
(YouTube, Vimeo, Instagram, DailyMotion, Soundcloud)
×
Se souvenir de moi
Mot passe oublié
Connectes-toi
M'inscrire