CORRECTAR LA LETRA

Letra : Gbese Gbese

It's Shy Beats
It’s your boy Kaptain
Argh argh ZaZa

Shey u tok say I be your guy
Why e be say I dey progress you gather people around dey preach lie?
You no know say if you give me your wings and I give you my wings
Say together me and you we fit fly?
You no know say if I get and you happy you get and I happy
Tell me how the account go fit dry?
Instead you dey happy I dey trek only you dey drive
You wan be my boss for the rest of your life
You no want mek I cash out abi you be guy man wey get black heart?
We dey hustle till the bee everyday on a steady we dey survive on last card
Well day must break again and old takers must surely take again
Breeze dey blow outside
You no fit tok say e go blow Ola no blow Ade
Chee!!

Igwe igwe igwe gwe gwe gwe
Igwe gwe gwe
Igwe gwe gwe igwese gwese gwese gwese
E don burst ×2

Chei omo I just say mek I tok say oluwa don break my saving box
I'm now looking different chee!

Gimme money you say money no dey
Gimme update you say update no dey
Show me the way you say you no know road
But for your neck you wear like 15 gold
See brother man reason am
How e for dey say you pull up inna Benz and I pull up inna Range
Tok say e no go make sense
Charlie tok say e no go mek sense
Instead I dey drink water you dey eye my cup
I dey cook beans you wan tek my pot
You see me with butter you dey hide your bread
You get plenty women you still dey eye my girl
Forget say frog no dey jump go back
This money no go follow us go back
So guy no dey loose guard your real guy
Cus inside life every guy man must see light
Chee!!


Igwe igwe igwe gwe gwe gwe
Igwe gwe gwe
Igwe gwe gwe igwese gwese gwese gwese
E don burst ×2

Chee! Omo I just say mek I tok say Oluwa don break my saving box
I'm now looking different chee!

Every guy man wan dey where im Gucci gang dey
Normal level
Chee!

It’s your boy Kaptain
Argh

Argh! It's Shy Beats